Coronavirus Symptoms: Full explanation of Covid-19 outbreak, everitin you need to know

0
852

Di Coronavirus wey start from one town for China for late 2019 don turn to global serious mata.

Di World Health Organization (WHO) wey be di joinbodi of sabi pipo wey dey torchlight health mata around di world, declare di Coronavirus aka Covid-19 disease as global pandemic on 11 March 2020.

Na exactly three months since di first Covid-19 patient Wei Guixian begin feel sick – and since den world goments dem don dey prepare to stop di spread and cure those wey e don catch.
Wetin we sabi about Coronavirus

Di virus, wey dem don officially name Covid-19, na new strain of coronavirus wey dem neva see for human body before.

Di virus fit affect di lungs, and cause cold and catarrh. E fit spread from pesin to pesin through coughing and sneezing.

  • Chloroquine fit control Coronavirus?
  • Garlic, ice cream, heat, odas dey among fake coronavirus advice you need to ignore

World Health Organization don advise pipo to avoid “unprotected” contact with live animals, and make dem cook meat and eggs well-well.WHO dey encourage pipo to do social distancing. Dis one mean say make pesin try to avoid touch-touch wit oda pipo, especially di ones wey dey show signs of di disease.

E also mean pesin go avoid wia plenty pipo dey or gada for, like bars, swimming pool, cinemas, restaurants, theatres, gym and social gathering.

  • Wetin China promise Nigeria ontop Coronavirus
  • Celebrities wey don get CoronavirusDi main symptoms include;
  • Difficulty to breath or shortness of breath
  • Fever
  • Coughing and sneezing.
  • E fit also lead to organ failure
  • Pneumonia
  • And Death

If pesin don dey in contact with pesin dem suspect say get coronavirus, or e don go area wey di virus don spread enta, di advice of health sabi pipo na to do ‘self-isolation’. Dis mean say di pesin go sidon put for house for at least 14 days, and make sure im no follow anybody do touch-touch during dat period.

 

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here