Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19

0
780

Sake of di Coronavirus outbreak, leaders of many kontries don advice dia population to take measures to prevent di spread of Covid-19 disease.

For those wey don get di disease or dey come from places where patients wey get di Coronavirus plenty, di professional advice na to ‘self-isolate’ (or self-quarantine).

But you sabi wetin self-isolate (or self-quarantine) mean and how to do am?

Di general medical advice be say, if you suspect say you get coronavirus, don dey in contact wit pesin wey don get am, or don dey wia plenty cases of di virus bin dey, den you need to self-isolate.

Dis na even if authorities never tell you to do am.

Watch di video to learn di correct way to do self-isolation.

How dis Virus dey spread

According to di World health Organization, dis new coronavirus na respiratory virus wey dey spread mainly through contact with infected pesin through discharge wey come out from di pesin. For example, coughs or sneezes, or through droplet of saliva or discharge from di nose.

Coronaviruses na zoonotic, meaning say na from animals na im humans dey contact di virus.
Pipo wey dey live or travel go area wia di CODVID-19 virus start (Hubei, China) fit dey for risk of infection. Those wey dey infected from oda kontries dey among pipo wey recently travel from China or wey don dey live or work closely wit those travellers, like family members, co-workers or medical rofessionals wey dey care for patient before dem know say di patient dey infected with di virus.

How to protect yoursef against Coronavirus

Who dey for more risk?

Older pipo plus those wey bin get medical conditions before (like diabetes and heart disease) dey for more risk to dey seriously sick with di virus, according to WHO.

Health workers wey dey care for pesin wey dey sick with COVID-19 disease dey for higher risk and must protect demsef with di correct infection prevention and control procedures.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here